07/02/2021
JESUS PRISH ON-TOP MOUNTIN
1.Wen Jesus si di pipol, e klimb go di mountin and en disciples follow am. Afta e don sidan, 2.e kon bigin tish dem sey;
3.“God go bless una wey dey poor for spirit,
na una go get heaven.
4.God go bless una wey dey mourn,
bikos E go make una happy.
5.God go bless una wey nor dey karry body up,
una go enjoy en promise for dis world.
6.God go bless una wey dey like to do good tins,
E go give una evritin wey una wont.
7.God go bless una wey dey sorry for pipol,
una go receive mesi.
8.God go bless una wey get pure heart,
na una go si God.
9.God go bless una wey dey make peace,
pipol go koll una God shidren.
10.God go bless una wey dey sofa bikos una dey do wetin dey rite,
na una go enjoy God Kingdom for heaven.
11.“God go bless una wey pipol dey curse, dey sofa and lie for una head, bikos of mi, 12.make una happy and make belle sweet una, bikos na big tin dey wait una for heaven. Make una remember sey, na so di profets wey kom before una, sofa too.”
Salt And Lite
13.“Na una bi salt for dis eart. But if salt nor get taste; how e go bi for pipol mout? E betta make dem trowey am and make pipol mash am.
14.“Na una bi lite for dis world and town wey dey on-top mountin, nor dey hide. 15.Pesin nor dey lite lamp kon kover am with basin, instead e go put am for where evribody wey dey inside di house go si am. 16.Like dat too, make yor lite shine well-well for where pipol dey, so dat dem go si di good tins wey yu dey do, wey go make dem praiz yor Papa wey dey heaven.”
Have a blessed week